song lyrics / Erigga / Wickedness lyrics  | FRen Français

Wickedness lyrics

Performer Erigga

Wickedness song lyrics by Erigga official

Wickedness is a song in English

Wickedness written by erigga

But you know say I get mouth sha
Ha haha feeling like nasty Nas
I swear bro hahaha e don burst

Dem get money waytin dey worry them
Dem get money waytin dey worry them
Chairmo Na me dey scatter the town


Xo don dear no dey turn am like that
Because of u I no fit post for my Watsapp
Cos u beg me I newly start wickedness
Make dem no go beg person poor for internet

Take money make u enter keke dey come
My car don full I no dey like carry pass four
You know say you no dey swipe u be short one
Dem put u for serious thinkin u start to bomb

Your corollla mistakenly on double pointer
Abeg off am u wan spoil our convoyed
Remove this cupboard which kind color u paint am
Ogun wan kill you if them born well u come forward

Them tell area say area no go fit blow
But where area don waka reach nobody know
How area come take burst with e champagne
Big name my moves dey put area for thinking

(Chorus )
Na the business be this I Dey put them for thinking
Na the business be this Na me Dey put them for thinking
Na the business be this I Dey put them for thinkin
Na the business be this Before them put me for thinking
Na the business be this no need to reason am
Na the business be this u get s***t hustle Na
Na the business be this my brother find money oh
Na the business be this nobody care about you

(Rap)
You never taste loud u say u know need Colorado
Only one puff warri turn Colorado
Head Don go video am for the jungle
Dey bark like dog ur brain no withstand the jumbo

Dem tell am say u be my guy come make we hustle
Money full this side die come make we bubble
U begin follow them dey stay everyday trouble
Them know say ur current low pack ur load dey go

Who stupid don stupid forget village people
Na Bovi act we don watch erare Okpoh
Ibori talk am that year Ede e rue Kaye
Nai dem dey know no worry I know my people

Dem pause family meeting who get money busy
Senior brother when no get (money) begin gbozigi
They speaks English waka whats the meaning of dis
Idiotcracy Na you know investor dey busy

(Chorus)
Na the business be this family put am for thinking
Na the business be this because e no geti chichi
Na the business be this them don put u for thinking
Na the business be this Na so the matter be

Na the business be this no need to reason am
Na the business be this u get s***t hustle Na
Na the business be this my brother find money oh
Na the business be this nobody care about you


(Rap)
If you think I am thinking what u think am thinkin
Your Thinkin is leaking pack am naw it’s stinking
Poverty dey make us argue michael Jackson shirt
My guy when say Na 1m we nearly beat am faint

One guy say e buy small coke 10,600
We argue the matter for area from ten reach 6
When we go begin stroll waka zabuzabu
No dey forget when dem clean me for eghogbadu

Gist lover Person open shop give e babe for lekki
Customer give am belle move am enter yanki
Because of Toto u Borrow money from online bank
Mama don block you and fuel no even dey ur tank

E be like say I go stop to dey post for WhatsApp
Cos once I do the billing Na another matter
My Landlord poshu me where I for dey stay
Drop azza I credit you carry am go spray

Mama don retire for government work
Mama never chop but e slippers don chop
Where my pension how far no be So talk
Waytin dey sup omo dem don put mama for thinking

Ose believe say one day Naija go good
Fake currency Nai dem buy Ose goods
Ask Ose waytin e use the money do
I spend am naw another don enter thinkin
Lyrics copyright : legal lyrics licensed by Lyricfind.
No unauthorized reproduction of lyric.

Comments for Wickedness lyrics

Name/Nickname
Comment
Copyright © 2004-2024 NET VADOR - All rights reserved. www.paroles-musique.com/eng/
Member login

Log in or create an account...

Forgot your password ?
OR
REGISTER
Select in the following order :
1| symbol at the top of the helmet
2| symbol to the right of the cloud
3| symbol at the bottom of the padlock
grid grid grid
grid grid grid
grid grid grid