song lyrics / Erigga / Wahala Dey lyrics  | FRen Français

Wahala Dey lyrics

Performers EriggaOga Network

Wahala Dey song lyrics by Erigga official

Wahala Dey is a song in English

Wahala dey
Wahala full here o
Country wey blind man dey count money
Wahala dey
Wahala dey
Wahala full here o
Armed robber dey call thief ole
Wahala dey

Oga DPO na who thief im phone for inside police station abeg
Nepa office on generator dem no no wen light go come

As I dey follow you dey talk all my men don off
The loud wey we dey smoke dem no fit drag pass one puff
We taya for Nigeria matter I no fit lie you
Na wetin Fela and Chana talk still dey happen
Who rule go waste money work he no go do
Hustle don make boys forget wetin den read for school
12 years 13 years don dey do Yahoo
Dey look Epa wen nor dey do like big Malu
Epa don graduate for Ekpoma but no level
He find work he tire he kukuma join HK
According to am the rain wey beat am today go wash im Benz tomorrow once e puma pay
For all the good men he dey jam no wan get shishi
I no fit judge d story don pass deeper life preaching
Since Jona no get patience he join taking
Na last week dem poof close to that bakery

Wahala dey
Wahala full here o
Country wey blind man dey count money
Wahala dey
Wahala dey
Wahala full here o
Armed robber dey call thief ole o
Wahala dey

Oga DPO na who thief im phone for inside police station wahala
Nepa office on generator dem no no wen light go come how dem wan take know

Dear abacha small thing fit reach me
The last one you send come area we no see shishi
Stay at home but where the electricity
Nigeria na cruise I swear God forbid bad thing
Wetin dey occur my whatsApp na Mandilas
View my status na shoe bag hair and slippers
15years no dey sleep house she don enter street
Dey sell pussy for lekki her Father against that shit
Cos na she dey survive dem alert steady
This generation don cast wen e go ending
Na Yahoo money make Aunty collect big slap cos 17years don too dey my snap
Nigeria now be like fowl wey no get owner
Who swear give us e no go better for una
Covid 19 grandchildren wey suppose give us cure
Don turn makeup artiste dey director pure

Wahala dey
Wahala full here o
Country wey blind man dey count money
Wahala dey
Wahala dey
Wahala full here o
Armed robber dey call thief ole o
Wahala dey
Oga DPO na who thief his phone for inside police station very bigi wahala o e dey here
Nepa office on generator dem no no wen light go come wahala dey here

Wahala dey Wahala dey o o o
This is country wey blind man dey count money o o o
Wahala full everywhere breketete breketete Swaps
Lyrics copyright : legal lyrics licensed by Lyricfind.
No unauthorized reproduction of lyric.

Comments for Wahala Dey lyrics

Name/Nickname
Comment
Copyright © 2004-2024 NET VADOR - All rights reserved. www.paroles-musique.com/eng/
Member login

Log in or create an account...

Forgot your password ?
OR
REGISTER
Select in the following order :
1| symbol to the left of the thumbs up
2| symbol at the top of the trash
3| symbol to the left of the clock
grid grid grid
grid grid grid
grid grid grid