song lyrics / Erigga / Victims lyrics  | FRen Français

Victims lyrics

Performers EriggaFunkcleff

Victims song lyrics by Erigga official

Victims is a song in English

Paper boy
Abeg
But you know some kind times when you go just dey
Dey reason some of your guys them
When be say you don lost from the struggle you know
Some of your guys when dey locked up
When dey do maximum for reminder
They just dey make you dey wan feel some type of way

Yeah feel at home no mean say you go enter kitchen
Go open pot serve food my brother listen
I no dey too smile you suppose know the reason
Half my squad don kpoof remaining dey prison
When we small we no believe say e go hard like this
Person go broke sotey e no go fit high like this
You never chop slippers don chop head fry like this
Do what I gats do because I no fit die like this
But area get the way e be unto police matter
So na sense na him we take dey carry things waka
Brand new iPhone X with second hand charger
Your babe wan buy no fear I no go too charge her
The last time when zone five burst enter jungle
Two seconds them don wear us government bangle
According to them all of us when sit down na thief
Drop bar give their oga na once na him them shift

Cause at all at all e no be an option
As we dey work so make the money for pile up
Bobo ball oh
Ojote remind us say no be only we dey find money oh
As e dey be so e no be a secret
Say everybody na victim
For the street everybody na suspect
Omo the matter is complex very too complex

Blood stain my polo the day them shoot Kowo for mumu matter
We dey where we dey chop owo
They say he die person money unto transfer
The matter pain me die because na mumu bar
For hundred Dollar gift card area fit shoot you
Run go hide two seconds them don root you
If you no get money to pay or get collateral
My advice stay away from transfer matter
I know boys for area when they no get joy
They no wan know who dey right their own na destroy
They don clock 45 but dey their mama house
Na everyday their family dey go settle SARS
Girl cheat dey dey ask what's the update
Make I update you make your boyfriend fly my gate
My area normally rough forget baby
I dey with my pampers incase they wan come pay me

Cause at all at all e no be an option
As we dey work so make the money for pile up
Bobo ball oh
Ojote remind us say no be only we dey find money oh
As e dey be so e no be a secret
Say everybody na victim
For the street everybody na suspect
Omo the matter is complex very too complex

Ya already no no
Lyrics copyright : legal lyrics licensed by Lyricfind.
No unauthorized reproduction of lyric.

Comments for Victims lyrics

Name/Nickname
Comment
Copyright © 2004-2024 NET VADOR - All rights reserved. www.paroles-musique.com/eng/
Member login

Log in or create an account...

Forgot your password ?
OR
REGISTER
Select in the following order :
1| symbol to the left of the television
2| symbol to the left of the suitcase
3| symbol to the right of the heart
grid grid grid
grid grid grid
grid grid grid