song lyrics / Erigga / Glasses in the air lyrics  | FRen Français

Glasses in the air lyrics

Performer Erigga

Glasses in the air song lyrics by Erigga official

Glasses in the air is a song in English

Omo you know say this life enh
E just get the way e take me
No be according to size dem take dey share am reach you
You no understand?
We know where we dey come from
cii My name na erigga paper boi
Congratulations
Glasses in the air for us when don try
Growing up no easy for us
Na we be those children when dey trek go school
But now we dey drive dey drop our pikin for school
Glasses in the air for us multiple stream of income
From MuMu to boss (big name )
Glasses in the air for us when no give up
Glasses in the air for us
I know how it feels to be this broke
Inside jungle dey beg May u see smoke
If i get you for buy na
Hunger dey kpi am, sapa dey tell am lié down
Remember when dey lie say pile get money
For us to fit in cos all their pile get money
Enter their house dey wonder see as their parlor big
But today I no remember how their parlor be
One of my guy mile warn me where I take fear my head
She say erigga why you dey wear only one shirt
Dey come this house from today no near that gate
Na money when man no get mama no go fit relate
If your papa na big man you no know watin
GOd don do for you, many people hang for waiting
So church dey full pastors dey cash out big time
The sign of the time dey burn money for annoting
Glasses in the air for us when don try
Growing up no easy for us
Na we be those children when dey trek go school
But now we dey drive dey drop our pikin for school
Glasses in the air for us multiple stream of income
From MuMu to boss (big name )
Glasses in the air for us when no give up
Glasses in the air for us
Mind set of the average trenches pikin
Na Watin to chop watin concern am with vacation
But today na still we the same we trenches pikin
Their own dey beg to carry them go ON vacation
The distance between you and success no far
Na you no wan waka fast dey follow MuMu crew
Below the poverty line watin wan make i do
The odds against us chances na 0.2
Reality don dey call you now answer big man
For small money see the way you spoil life throway
Life precious no use am play gamble big man
Na why two of us no fit waka, go reach today
Toast to the nights when dem say make who no get shut up
Lock up no talk watin you wan contribute
Bag of nothing plus bag of nothing equals to nothing
Na why we find money like if you move we shoot
Glasses in the air for us when don try
Growing up no easy for us
Na we be those children when dey trek go school
But now we dey drive dey drop our pikin for school
Glasses in the air for us multiple stream of income
From MuMu to boss (big name )
Glasses in the air for us when no give up
Glasses in the air for us
Omo make I tell you something enh
You see this game called life you dey win my brother menh
cnything you do you dey win but na you go decide the kind win you wan win
Because your brain dey wired to win you no understand?
Check am out if you tell ur self say you wan make money you go make money
But if you say you no wan make money so far you believe am you no go make
money na so life be
Toast to the night when be say nothing dey to eat
But right now I dey one big buffet I no know watin to eat
Day break everywhere burst men family time baby
Make we go shop !!!
Lyrics copyright : legal lyrics licensed by Lyricfind.
No unauthorized reproduction of lyric.

Comments for Glasses in the air lyrics

Name/Nickname
Comment
Copyright © 2004-2024 NET VADOR - All rights reserved. www.paroles-musique.com/eng/
Member login

Log in or create an account...

Forgot your password ?
OR
REGISTER
Select in the following order :
1| symbol at the bottom of the house
2| symbol to the right of the camera
3| symbol at the top of the helmet
grid grid grid
grid grid grid
grid grid grid