song lyrics / Blackfacenaija / Mathematics lyrics  | FRen Français

Mathematics lyrics

Performer Blackfacenaija

Mathematics song lyrics by Blackfacenaija official

Mathematics is a song in English

Omo the matter pass me oh
I solve solve omo I no even get any answer at all
cbeg which eh formula you feel say I for take take solve this our Naija matter because eh
E tire me

Solve the mathematics
What the F is this yo
Wey dey trouble we so
Oya Oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Wey dey trouble we so

These people them bad these people them kala
Put we ina suffer-ration new day new wahala
Those wey dey enjoy na those wey dey power
While my people gat no light No food them dey suffer
We no know where we dey go
Be like say na blind men dey lead the road
Media dey do them own
cnd white go turn black them want make we no no know
Na which kain thing be thief I thief you dey feel my plea
if them give them chance them go make life hard instead of make life sweet
To solve the puzzle for the bottle
We gat's shine our eye to see politicians them wan use us die and ah
We are the lions for the jungle
Time to fight for your right my people make we do the maths
Oya oya

Solve the mathematics
What the F is this yo
Wey dey trouble we so
Oya Oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Wey dey trouble we so

Why we no get light
We no know
Why no good roads
We no know
The budget for the project in the projects in the ghetto when e go complete
We wan know
Why insecurity high
We no know
Eh Eh Na herdsmen
We no know
I hear some politicians are their sponsors and some of them are amongst us
Tell me why them dey
We wan know

Government this and Government that
Na their people them dey give e contract
Political appointment na their house e start
What of my brothers and my sisters
My sisters
One Nigeria ne'
Ogbeni wetin you want tell me again
I pledge to serve my country with all my strength No go ask me wetin I gain
So wetin bring division between Idomas and Igbos
Yoruba Hausa dey do igbati gbos
Ipobs and bandits them loyal to the boss
cnd politicians them dey do like them no know huh
Why cost of living dey high
Why e be say na only the rich be getting by
Politicians budget for them furniture dey cost pass our children education
Somebody tell me why why why why

Solve the mathematics
What the F is this yo
Wey dey trouble we so
Oya Oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Wey dey trouble we so

Why we no get light
We no know
Why no good roads
We no know
The budget for the project in the projects in the ghetto when e go complete
We wan know
Why insecurity high
We no know
Eh Eh Na herdsmen
We no know
I hear some politicians are their sponsors and some of them are amongst us
Tell me why them dey
We wan know

If you ask me na who I go ask
These politicians them don Marra They don't know how to act
If you ask me na who I go ask
These politicians them don Marra They don't know how to act

Giddem money to repair our roads
Wonkoje'
Giddem money to upgrade hospitals
Wonkoje'
Giddem infrastructural money
Wonkoje'
cwonwere'
Wonkoje'
Money wey go give my people light
Wonkoje'
Money wey go give my people water
Wonkoje'
Money wey go give my people house
Wonkoje'
cwoni'eranu
Talo'koje Charley
These questions wey we dey ask my people I believe say we dey up to the task
cnd this not be time to relax till the politicians come up with the facts
Oya make we

Solve the mathematics
What the F is this yo
Wey dey trouble we so
Oya Oya
Solve the mathematics
What the F is this yo
Wey dey trouble we so

What
Hard life na the first one haha
Tell them say me back with another
Politicians huh , if you can't make Naija better dont make it worse for us
Let us be prosperous
Eden kill them with the beat
No surrender No retreat
cwol
Lyrics copyright : legal lyrics licensed by Lyricfind.
No unauthorized reproduction of lyric.

Comments for Mathematics lyrics

Name/Nickname
Comment
Copyright © 2004-2024 NET VADOR - All rights reserved. www.paroles-musique.com/eng/
Member login

Log in or create an account...

Forgot your password ?
OR
REGISTER
Select in the following order :
1| symbol to the left of the suitcase
2| symbol to the left of the thumbs up
3| symbol at the bottom of the heart
grid grid grid
grid grid grid
grid grid grid