song lyrics / Vsagz featuring Parpae / Sunrise lyrics  | FRen Français

Sunrise lyrics

Performers Vsagz featuring ParpaePARPAEKaptain

Sunrise song lyrics by Vsagz featuring Parpae official

Sunrise is a song in English

Aye! mama ,aye mama mama mama
Aye! mama(no no woah) ,aye mama argh uh argh uh
Sha nothing like too much blessings
And nothing like too much wisdom
I want everything i no want some
Cos life’s too short , life is tempting
Omo aye dun, aye dun gan
So i let bygones be bygones
Lord i need your mercy now cos they wanna see me fall
So you on guard from the sunrise to the sun down,
No let dem use me japa o
Make e morale no for run down
So you on guard from the sunrise to the sun down,
No let dem use me japa o
Make e morale no for run down

Who hustle no invest go hustle again
So use your head because block fit no come again
And when e stew for you my brother share bread
Na only lizard know wetin e see wey make am nod head
Brother show me love when I no strong because table dey turn
So ogbeni no dey feel fly
You dey buga with your Benz you dy use am take dey form ehn
Na normal taxi for Dubai
So no come here dy carve style jhor
Wetin dey sup?
Your shoulder no be elevator
No dey carry am up
No show me latest club show me where you dy bomb
People food don ready since I still dy wait my pot
So baba make the money come make e repkete
Make the girls come make e rekpete
Baba make the blessings come make e rekpete
Opor,opor make e rekpete!

So you on guard from the sunrise to the sun down,
No let dem use me japa o
Make e morale no for run down
So you on guard from the sunrise to the sun down,
No let dem use me japa o
Make e morale no for run down

Everybody get their own broke limit (gbecheche gbechecheche)
Money wey you take dey carry body
Person fit get am say e broke finish (gbecheche gbechecheche)
Figure wey dy give you heart attack
Naim Khalifa just spend finish (gbecheche gbechecheche)
So calm down person fit start to activate
Immediately as you ball finish (gbecheche gbechecheche)
So if you dey pray for money make you pray make e last
You dey pray make e last make you pray you last
You dey pray make you last make you pray for your guys
If everybody get then nobody go ask
Abi you no want make the convoy long?
You no wan pull up in Maserati line with your squad
Ogbeni make you reason am
For your real guy no form busy man

So you on guard from the sunrise to the sun down,
No let dem use me japa o
Make e morale no for run down
So you on guard from the sunrise to the sun down,
No let dem use me japa o
Make e morale no for run down(oh no no no no)

See dem dey talk as i dey do
Dem say my style too mezebu
But as family dey bellefull
Omo me I’m good
Nobody know your story like you oh no..
And nobody fit give you glory like you oh oh

Aye! mama(yeh yeh)aye mama mama mama
Aye! mama(no no woah) ,aye mama argh uh argh uh
Lyrics copyright : legal lyrics licensed by Lyricfind.
No unauthorized reproduction of lyric.

Comments for Sunrise lyrics

Name/Nickname
Comment
Copyright © 2004-2024 NET VADOR - All rights reserved. www.paroles-musique.com/eng/
Member login

Log in or create an account...

Forgot your password ?
OR
REGISTER
Select in the following order :
1| symbol to the left of the heart
2| symbol to the left of the target
3| symbol to the left of the bulb
grid grid grid
grid grid grid
grid grid grid